University of Abuja
Inception | 1 January 1988 |
---|---|
Official name | University of Abuja |
Native label | University of Abuja |
Affiliation | National Universities Commission |
Motto text | For Unity and Scholarship |
Kontri | Naija |
Located in the administrative territorial entity | Abuja |
Located in time zone | Central European Time |
Coordinate location | 8°58′49″N 7°10′49″E |
Memba of | African Library and Information Associations and Institutions, Association of African Universities |
Headquarters location | Abuja |
Language used | English langwej |
Color | green, white |
Official website | https://www.uniabuja.edu.ng/ |
University of Abujana yunivasiti wey dey Abuja di kapita of Naija. Na for January 1988 dey form di skul (onda decree No 110 of 1992 amended). Di risin dey form di skul na to tich student wey kom di yunivasiti kampos or di student wey dey online di tins wey oda skul sef dey tich. Dem stat to tich for di yunivasiti for 1990 wit di fest grup of student wey stat di skul.
Tori abaut di skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Di yunivasiti stat for one tempoari land wey dey fest wan yuz for pamari skul for Gwagwalada. Di nem wey dey giv dat tempoari land na 'mini- kampos'. Na for di mini kampos de fest stat to dey tich for 1990 afta wey di yunivasiti kom pak go di big land wey kova 11,800 acres wey dey di road wey go Abuja City Airport. Di yunivasiti of Abuja main kampos get three wuman hostel an two bois hostel an na plenti student dey liv dia. Di ofis of distant learning dey for Abuja aria (Area 3 Garki).
Akademi
[chenj-am | chenj-am for orijin]University of Abuja dey du Diploma, Under Graduate an Post Graduate course an Central for Distance Learning. Di Falkoti an kolej wey dey di yunifasiti bi:
- Falkoti of Agriculture
- Falkoti of Art
- Falkoti of Education
- Falkoti of Engineering
- Falkoti of Law
- Falkoti of Management Sciences
- Falkoti of Sciences
- Falkoti of Social Sciences
- Faculty of Veterinary Medicine
- Falkoti of Post Graduate Studies
- School of Remedial Studies
- Kolej of Health Sciences
- Kolej of Medicine
- Th institute of Legislative Education