Lauren James
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | UK |
Country for sport | England |
Fest nem | Lauren |
Famili nem | James |
Wen dem bon am | 29 September 2001 |
Ples wey dem bon am | London |
Broda an sista | Reece James |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
Wok wey e dey du | association football player |
Position played on team / speciality | forward, midfielder |
Wie e go skul | Twickenham Academy |
Member of sports team | Arsenal F. C., Manchester United W.F.C. |
Sport | association football |
Lauren Elizabeth James (dem bon am on 29 September 2001) na English profeshonal futbola wey dey pley front for Women's Supa League klub Chealsea an di England Women's Nashonal teem.
Hau e stat life an skul
chenj-amDem bon Lauren James on 29 September 2001 in London. Shi get Grenadian an Domican blood fom im papa, an English blood fom im mama.
Na Whitton Skul wey dey Whitton, na im shi tek go skul.
Im klub wok
chenj-amArsenal
Na Arsenal dikova James web shi dey 13 years old. On 29 October 2017, James pley fes match for Arsenal, shi enta 67th minutes, na Lisa Evans shi enta for insaid 2 - 0 match win wit Everton in 2017 - 18 season. Na shi bi di sekond playa wey smol for age wey go pley for Arsenal.
Manchester United
On 13 July 2018, dem tel pipu sey James go dey insaid playas wey go pley for Manchester United in di 2018 - 19 FA Women's Championship. Shi pley im fest match for Manchester United wen dem pley wit Liverpool on 19 August, na dem win di match 1 - 0.
Chelsea
On 23 July 2021, James sign four years kontrat wit Chelsea. Shi skore im fest goal for di klub insaid 9 - 0 win wit Leicester on 27 March 2022. Na shi win Young Playa of di Year Awod, bikos of hau shi tek pafom for 2022 - 23 season. In June 2023, James sign kontrat wey go mek am stil dey for Chealsea til 2027.
Kontri wok
chenj-amYouth
In April 2017, James pley im fest onda - 17 match insaid 2 - 0 win wit USA. On 14 October 2017, shi kaptain England for 10 - 0 win wit Lativa as pat of d i2018 UEFA Women's Under - 17 Championship qualification, shi skore four goals.
In January 2019, dem kol James to kom pley for Under - 19 for di Algarve Tournament. In July 2019, James nem dey insaid England's teem for di 2019 UEFA Under- 19 championship in Scotland.
Sinior
In November 2020, Dem fest kol James for sinior nashonal teem kamp at St. George's Park.
James fest pley for sinior teem on 3 September 2022, wen shi enta for anoda playa for England in di 79th minute for 2023 Wod kup qualification match wit Austria.
Shi skore im fest internashonal goal on 16 February 2023 wen England win South Korea 4 - 0 insaid 2023 Arnold Clark Kup.
On 31 May 2023, James nem dey insaid playas wey go pley for di 2023 FIFA Women's Wod kup. Shi skore Di onli goal insaid England's 1-0 win ova Denmark in dia sekond Grup D match, shi kon stil skore 2 goals, three assist an a playa of di match parfomans wit China in dia final grup match. Insaid knock out stej for 2023 FIFA Women's Wod Kup, James Kolet Red kard bikos of roff pley wey e du Nigeria playa na dem leta win di match wit penalties.
Pasonal life
chenj-amLauren na sista to Chelsea an England's difenda Reece James. Na dem bi di fest England broda an sista playas wey go pley for England sinior teem.
Shi tok sey na im papa e dey luk as ezampu for futbol. Im papa Nigel, na UEFA licensed refree.
Hau e tek wok for teble
chenj-amKlub
As of match wey e pley on 27 May 2023
Club | Season | League | Women's FA Cup|FA Cup | FA Women's League Cup|League Cup | Europe | Total | ||||||
---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|
Division | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | ||
Arsenal | 2017–18 | WSL 1 | 5 | 0 | 0 | 0 | 3 | 1 | — | 8 | 1 | |
Manchester United W.F.C.|Manchester United | 2018–19 | Championship | 18 | 14 | 3 | 2 | 6 | 1 | — | 27 | 17 | |
2019–20 | WSL | 12 | 6 | 1 | 1 | 5 | 2 | — | 18 | 9 | ||
2020–21 | WSL | 10 | 2 | 0 | 0 | 1 | 0 | — | 11 | 2 | ||
Total | 40 | 22 | 4 | 3 | 12 | 3 | — | 56 | 28 | |||
Chelsea F.C. Women|Chelsea | 2021–22 | WSL | 6 | 1 | 3 | 0 | 2 | 0 | 1 | 0 | 12 | 1 |
2022–23 | WSL | 18 | 5 | 4 | 0 | 3 | 1 | 8 | 2 | 33 | 8 | |
Total | 24 | 6 | 7 | 0 | 5 | 1 | 9 | 2 | 45 | 9 | ||
Career total | 69 | 28 | 11 | 3 | 20 | 5 | 9 | 2 | 109 | 38 |
Goals wey e don skore
chenj-amNo. | Date | Venue | Opponent | Score | Result | Competition | |
---|---|---|---|---|---|---|---|
1 | 16 February 2023 | stadium MK, Milton Keynes, England | KOR | 4–0 | 4–0 | 2023 Arnold Clark Cup | |
2 | 28 July 2023 | Sydney Football Stadium, Sydney, Australia | 1–0 | 1–0 | 2023 FIFA Women's World Cup | ||
3 | 1 August 2023 | Hindmarsh Stadium, Adelaide, Australia | 3–0 | 6–1 | 2023 FIFA Women's World Cup | ||
4 | 4–1 |
Honors
chenj-amManchester United
- FA Women's Championship: 2018–19 FA Women's Championship|2018–19
Chelsea
England
Individual
- Women's Super League Goal of the Month: 2022–23 Women's Super League#Monthly awards|February 2023
- FA Women's Championship Player of the Month: September 2018
- North-West Football Awards Women's Rising Star: 2020
- Arnold Clark Cup Player of the Tournament: 2023
- Arnold Clark Cup NXGN Player of the Tournament: 2023
- London Football Awards Women’s Young Player of the Year: 2023.